Sunday, November 15, 2015

Common Warri Proverbs...

"Crase no hard to form, na the trekking be wahala.
" English translation: "Easier said than done.

"No matter how hot your temper be, e no fit boil beans.
" English Translation: Calm down, your temper won't solve the problem.

"Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
" English Translation: You can't run away from your destiny.

"Today's newspaper na tomorrow Suya wrap.
" English translation: Keep calm! Nothing lasts forever.

"Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef.
" English Translation: Just be patient. Let the game come to you. Don't rush!

"Akara and moin moin get the same parent,na wetin dem pass through make dem different.
" English Translation: How you start doesn't matter, what matters is how you finish.

"Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus.
" English Translation: Give everyone what they deserve.

"The difference between puff-puff and doughnut na packaging." 
English Translation: Don't judge based on appearance alone.

"Escort me, Escort me, na im slave trade take start.
" English translation: Serious things sometimes start like a joke.

"Water wey dem take make eba no fit return".
" English translation: Don't cry over spilled milk.

"No be today yansh dey back"
English: The more things change the more they stay the same
 
"Na clap dem take dey enter dance"
English: Once you start its out of your control

"At all at all na winsh"
English: Half bread is better than none

"I get am before no be property" 
English: Don't rest on your laurels

"Who no go no know"
English: Experience is the best teacher

"NO be the way dem take dey drink water dem dey drink peppersoup"
English: Adapt your plans to new situations

"I no fit climb - na ground dem for dey talk am"
English: Do not start what you cant finish

"Who dey cry dey see road"
English: Use common sense even in sorrow

"I no gree, I no gree na im dey tear trouser
English: Avoid conflict from the beginning...know when to let go

"Na cooperation make rice dey ful pot"
English: You can achieve more with team work

"Feel at home naim dey spoil TV"
English: Don't be too comfortable to the extent of fiddling with other people's property

"Bring suya, bring suya, na nama (cow) body dey suffer am"
English: every action has a consequence

"Pickin wey take agbada start guy go talk wetin go wear when e don old"
English: Slow and steady wins the race. Don't hurry through life's stages.

"Cassava today naim dey be garri tomorrow"
English: No condition is permanent

"if your neigbour bear bear catch fire, you go quick soak your own for water"
English: Prevention is better than cure

"Small pikin wey talk say e go shake iroko tree,na im head e go shake"
English: Know your limits

"Person wey borrow cloth go party no dey dance too much"
English: Use other people's things carefully

"Who get big teeth must get big lip"
English: Be ready to solve the problems you create

"Its a small world - Oya make your papa come trek am na"
English: Easier said than done

"Na house wey collapse na im make goat climb am"...
English: People who ordinarily should not be up to you will take advantage of your downfall.

SAN

1 comment: